Skip to main content

Conversation with Angry Man.

March 5, 2010
First published on FACE BOOK ON:  Thursday, 11 February 2010 at 07:00 gring gring!gring gring!

 

Hello! Voice: Is this Garrick? I mean Garrick kehinde Kings Osemwengie? GKK: Yes, may I know whom I am speaking with?
Voice: Idiot! busy body! so you are that ignoramus, that go about attacking me from corner to pillar,pilar to post. You know law? you go school? Ibunye?
GKK:Please may I know whom I am speaking to?
Voice: well for your stupid information , na mi ; Micheal Aoodokaa, wey you dey talk rubbish about.
Gkk: Ah! oga; congratulations for your expected demolition to Minister of Special duties; you can see that you are a very special case to Nigeria , na i'm make Baba Jonathan first give you special treatment quick, quick.
Aondoakaa: You are a bascalay foooooool! you are gbon gbon cigar, you are ; (cut's in) GKK: Ogami why you just dey vex like this ,?
Aondookaa: God punish you, all of una; wey put san san for my gari; save your soul group; enough na enough, That yeye man wey nor dey dye him hair Soyinka,that one wey trowey bible come dey march like Oshiomole, wetin be dat yeye Pastor name again oh! (cut's in ) GKK: Bakare; )Ehennnn! All of una plus those old men wey nor know them sef, Shagari plus Ekweme na una do me like this so?

GKK: Bros heeeee!why you come dey yarn opata as if say na only you get sense sef? You see black ,you call am white you see white, you call am blue; which one you nor dey sef? Aondoakaa: You be real fool........ wetin dey worry you sef? u nor get sense? nor be chop I come chop?wetin concern agbero with overload? wetin u know? ok.... make I yarn you listen... mumu....dem say I be Attorney general , Wetin concern me corncern the ATTORNEY wey them add join am; wetin? I only collect the GENERAL CONTRACTOR WEY DEY INSIDE. na di general contractor work wey I dey do na i;m una nor let me see road. every day, every day, anaconda; anaconda na only me dey craze for goverment? see Ruma, nor be craze him dey craze wey dem they make me craze? na wah oh! see me see wahala; I just call make I beg u say dis new fosition wey I dey, if I begin drag them again nor talk oh; because na my own I dey do, you hear me now?
GKK: Bros me; I hear .Only say I still dey wounder why you come dey do the kind of things wey you do? you pursue Ribadu so tey , una come send am to exile, demote am, see Rufai una lie for him head begin pursue am wetin be all dis una nor get shame?
Aondoakaa :Na now I know say nigerians nor dey reason at all, at all .Ribadu? ehe heh ehe; if we nor spoil him name, how we go take drive am? if we nor drive am, how we go take thief; Ribadu sef; him nor dey hear abeg at all, we beg am sey free this men , him nor hear, word; every time charges ,charges, (cuts in)GKK: which men? Aondoakaa: my oga dem now, dem Ibori, Kalu, Akume,all the former theif theif governor, him nor let them res, wetin i go do now, oyibo say na who pay piper na buy tune;as for Rufai; that small devil, hmm why we no go pursue am, if Rufai dey gofement we go fit thief? answer? we for fit kidnap Yardua? him for don shout tey tey before Dora come dey make mouth; infact I dey vexxxxx: GKK: Rufai nor be Efcc, nor be police why una dey fear am?
Aodoakaa: that man ...Rufai, him for come be Baba Sallah pally, him for dey advise UMYA say see as things suppose to be nor be as we dey talk, and him for don tell the world before now say na wee kidnaaap UMYA.That one wey report Senate to the world , wey bulldoze all the house wey nor dey Abuja master plan. That snake, na him una say make we put for pocket make him expose all our dirty lies?nor be me oh?Rufai ,kai we nor wan see am oh!him like make him go court so tey him money go finish , na as I dey talk na him Judge go talk; (cus in ) GKK: you don forget say you nor be Attorney General again? Aodoaaka: hmmmm: dat wan na true oh; any way you sef nor dey hear word, I nor first be Attorney ; na only General contractor wey dey in side na him I take. so i go jus dey do my own go round all d judge. na now nobody go shout my name again;
GKK: wey UMYA?jus tell me the truth; nobody dey hear us now. Aodoakaa: You deaf sef? I say we kidnap am. (Cuts In )GKK: how many of una? we many oh! Turai;Ibori, Saraki, Ruma,Abaji;infact if i begin call names my credit go finish.(cuts in;Eheneeen) wetin be ehen?na new thin? every body know how him dey do him thin; Turai nor first kidnap am for Katsina? why una come they shout now? because na President? anyway UMYA nor like wahala so anything him go tell you say make you go meeet madam and if you meet madam she go tell you wetin you wan here.
GKK :So why una come dey play with Nigeria since, he don well, he don come, he dey play golf, he dey punch Turai, he dey talk for BBC, wetin why una nor let Jonathan be rule before? Aodoakaa:This man I bow for you oh! supposing say I dey were you dey na slap I for just slap you; you get sef sense? you don see who dey remove sugar for him mouth put am for another man mouth?Well I know say na reall jealousy dey worry you.That dey wey we go high court for Abuja, I see as you dey look the mopol wey dey follow me, and as the siren wey dey blow waoh! waoh,waoh! and my very fine flashy official car,if I ask you the car name you go know am? ok wetin be the name? (Cuts in ) GKK: d car look like helicopter. Aondookaa: oh !oh! you see you villager you never see am before ,na im make you dey jealous. that car na 2013 pegeout milenium model; na him make all of una dey jealous me nor be say I do una anything.
GKK: so wetin you go come do now as things be like this?
Aondoakaa: All work na work , only say na so so file and memo na im I go dey write now, all the egunje just go like dat.he nor go better for all enemy of progress wey nor let me progress.(cuts in) GKK: bros i wan drop oh, I don tire for dis ur curse.Aondoakaa: nor tire oh! na u start am oh; I go do all of un em; wen UMYA show face, him go make me General contractor again afterall na him load nearly break my kneck before.ok na bye bye.
Garrick kehinde Osemwengie Kings. Public Affairs Analyst/ Politician.



googletag.cmd.push(function() { googletag.display('comments'); });

googletag.cmd.push(function() { googletag.display('content1'); });

googletag.cmd.push(function() { googletag.display('content2'); });